Osakpamwan



Meanwhile, for inside Osakpamwan taizi as he dey drive pass Oba Palace:











Sunny: Bia, no be bat dey fly so? Ah tink na dis bat dey cause Ebola? Why dem still dey hia?

Prince: Oga, where dem go go na?

Sunny: Not fumigayshon dem call am? Make dem blow am for air jare make e kill dem all.

Osakpamwan: So, you mean say you no fit chop bat meat?

Sunny: Tufikwa. Me, chop bat meat? Ah no wan die, biko. Ah neva reach. If na dog meat you tok, ah go hia.

Prince: Oga, you dey chop dog meat?

Sunny: Ma broda, dog meat na the best meat ah don test for ma life.

Osakpamwan: True? How e dey be for mouth?

Sunny: Ah no sabi but ah know say wen ah chop am e sweet. Ah no fit deeskribe am.


Willy: Oga driver, dog meat na helele. No be small something dey there o. I dey feel dog meat wella because the water dey cure fever. If dem use am cook pepper soup come slice yam put. Mbok, na brain you go hear am. No be "essential" dog o, dat one no dey sweet. Na dose strong one I dey tok so.

Sunny: Nkita!

Willy: Gbam!

Selina: The Lord forbid! I no fit eat doggie meat o.

Willy: Madam, no tok am o. You wey be woman so, use am cook for your husband. You go see the efficacy and reaction of the man. He go just dey feel you anyhow.

Selina: Ehen?

Osakpamwan: So u dey recommend dog meat for us now?

Willy: Oh yes, very good. Try am, na so so dog meat u go dey find up and down now.

Sunny: Na dis dog meat ma babe take hole me for wok so. Ah neva see her dross one day but I die dia!

Nosa: Na true sha! I like dog meat well well. But people dey crase o. One day, I go my friend house, I meet say all of dem dey cry. Naim I ask say "ah, wosunu?"(What's happening?), dem say "Presley whu"(Presley is dead). Ina weh, domwan na ti Epresley(I now asked who Presley was). Iyan weh ekita iyan noh(they said its their dog). The small pikin dey cry dey roll body for ground. Ina tama eh weh "gu nu weh vbe vba"(I now told her to shut up). Usai! Dem do burial for the dog o. Before I come dem don bury am if not I for roast am chop.

Pastor Ken: God tell Peter say chop everything you see. Chop all. Everything clean now because we are in Christ Jesus!

Sunny: Dazall!!!

Willy: Gbam!!!

"Hmmm" Osakpamwan said as he sped on!

Comments

Popular posts from this blog

Of Dreams

Choose Right

Dance Of The Flames