Osakpamwan
Meanwhile, for inside Osakpamwan taizi as he dey drive pass Oba Palace: Sunny: Bia, no be bat dey fly so? Ah tink na dis bat dey cause Ebola? Why dem still dey hia? Prince: Oga, where dem go go na? Sunny: Not fumigayshon dem call am? Make dem blow am for air jare make e kill dem all. Osakpamwan: So, you mean say you no fit chop bat meat? Sunny: Tufikwa. Me, chop bat meat? Ah no wan die, biko. Ah neva reach. If na dog meat you tok, ah go hia. Prince: Oga, you dey chop dog meat? Sunny: Ma broda, dog meat na the best meat ah don test for ma life. Osakpamwan: True? How e dey be for mouth? Sunny: Ah no sabi but ah know say wen ah chop am e sweet. Ah no fit deeskribe am. Willy: Oga driver, dog meat na helele. No be small something dey there o. I dey feel dog meat wella because the water dey cure fever. If dem use am cook pepper soup come slice yam put. Mbok, na brain you go hear am. No be "essential" dog o, dat one no dey sweet. Na dose strong one I dey tok so. Sunny: Nkita! Will...