Osakpamwan The Taizi Draiva
Inside Osakpamwan Taizi ... Osakpamwan: Abeg, na one one fifty to Ugbor road o! Chuma: Tufiakwa! Paul: Ha! Chief Ben: Shuuuuu! Pastor Moses: Chineke! Nosa: 'Salobua! Charles: Awiloooooo! Doc Frederick: Dammit! Hehehehehe! Osakpamwan: Na so e be o, my pipo. No pentro for Bini. Paul: But why you no tok am for park na? Oda taizi been dey load hundred, hundred naira. I for kukuma enta dat wan na! All: Abi o! Osakpamwan :(unsmiling) I tok am, maybe una no hear. Mudiaga: Lai lai! You no tok anytin lai dat. Which kain rubbish be dis na? Osakpamwan: If una no go pay make una con dan make I revise o. We neva too go far. Mudiaga: Revise go wia? When we don go far? And you know say we no go see anoda taizi for hia. Na wicked be dat na. Chuma: Bia, wetin be the mata wit you? Ah tink somtin dey wrong for ya hade. Wetin ah go tell ma babe say ah yuze the balance 50 naira do? She kakulate all the money for ma hand. Make una see me wahala! Osakpamwan: No be m...