WHERE YOUR GUY??????????
Gloria: hey Mimi,wats up?
Mimi: I dey o,how far na?
Gloria: my dear I dey fine. How u dey? How ur guy?
Mimi: I bam o. Wetin dey happen?
Gloria: nothing much. I just dey. Wat of ur guy na.
Mimi: na wa o. E don tay. How ur side?
Gloria: my side dey. I just close from work. Wat of ur guy?
Mimi: really? Where u dey work?
Gloria: na civil defense. Where dat ur guy?
Mimi: really? Cool. I dey work for immigration.
Gloria: dats great. Na d same field we dey. So how ur bobo na?
Mimi: na wa o. Two years ago,we no get work o,now e don pure.
Gloria: yes o,na marriage remain. So how far with ur guy.
Mimi: yeah
Gloria: Mimi?
Mimi: yes?
Gloria: WHERE YOUR GUY? Your boyfriend?
Mimi: babe,u no wise at all o. U don ask me about my guy 82 times I no answer yet u no wan rest. Dem send u come abi? Person wen I dey try to forget since u wan resurrect am. U be winsh?
Gloria: shuuuu,girl I just dey ask na since una love tight dat time I feel say una still dey na
Mimi: hmmm,the guy monkey big time o. He break my heart.
Gloria: chei! Sorry o. Dat guy wey get innocent and sweet baby face? I tok am. All these fine boys,no need o.
Mimi: hmmmm. Ehen wat of Goffrey? Dat ur fine boyfriend?
Gloria: ehn????? Goff wetin? Dat guy wen tell me say I be him sunshine and star,say he go go moon go bring water for me take baff,wen go dey busket my neighbour?
Mimi: okokobioko! Ah! All these fine boys oooooo. Chei!
Gloria: eeeeee! The girl come even get belle for am sef. Na dat straw finally destroy the full camel. I nearly die o but na God help me. I don even get new guy now.
Mimi: really. Dats my girl jor. Me I neva get sha cos d guys I dey see now no just fine at all.
Gloria: hahahhahaha. After fine boy chook hand for ur eye u still dey look for fine boy? Are u a learner?
Mimi: ah,ur guy no fine?
Gloria: hmmm! if u see am ehn? Wor wor grip him gullet o and I like am well well cos babes no just dey send us at all. Dem dey give us chance,dey clear road as we dey come. The sweetest thing be say he no get money join,so na heavy groove I dey. The guy love me die!!!!!
Mimi: really? Ah! I no know if I go fit friend guy wey no fine o.
Gloria: really? Ok,na no wahala. Meanwhile,take IV for my wedding.
Mimi:(opens the envelope and peers at the picture) blood of Jesus! Gloria,na esu be dis o.
Gloria: (smiling contentedly)yeah,dats it. I love dat reaction. My papa shock wen he see am and tears gather for my mama eyes wen she see am. I like am well well. Even winsh sef no go disturb us cos him face alone go threaten dem. I love am. I'm very happy,dats what matters.
Mimi: ah,Gloria,consider ur children. Dem go wor wor too o.
Gloria: no worry,my blood strong pass him own so the wor wor no go tight like dat. Don't worry I have it all figured out. Ok na,I dey go select aso ebi. Make sure say u come o. Goodluck finding ur fine boy o(she walks away,laughing)
Mimi: (looks at the picture again,shudders and says to herself) abi,na true Gloria dey talk?.........
Comments
Post a Comment